By Nancy Mbaegbu
In this our Naija, where getting visa na like winning jackpot, Minister of Aviation and Aerospace Development Festus Keyamo, SAN don land inside one hot pot of scandal stew. The gist be say he allegedly used ministry power and funds to fly in his American babe and her mama from New York to Abuja, like diplomatic package. Love don upgrade o, dem say na first class romance with taxpayers’ money now!
Zainab, the babe wey dey for center of the drama, talk say she met Keyamo at a UN event in New York, where she dey work as translator. One aide just waka come meet her say “Oga wants a photo,” and before she fit say jack, minister don land inside her DM.
From “hi” to “relocate to Nigeria,” everything moved faster than black market dollar rate. Within one week, he meet her mama, promise her job, soft life, and all the sugar daddy benefits wey follow political potbelly.
But one small wahala dey. Zainab’s mama no get valid visa. But that one no shake our honorable minister. According to her, Oga say make dem use Emergency Travel Certificate because when love dey hot, protocol dey bend. Dem fly business class go Uganda (yes o!), since Oga dey flex for Dubai and no want make dem land Naija first. As mama get small Ugandan roots, e turn perfect cover story to “meet family” wey she only sabi from WhatsApp display pics.
From five-star hotels to convoys, maids, bouncers, and daily allowance, Zainab claim say everything was funded by Keyamo through ministry money. When dem finally relocate to Naija, na private jet land dem straight inside Abuja presidential wing. No immigration, no customs or security wahala. She say she never stamp passport once. Oga’s aide dey handle everything.Country hard, but some people dey live like season film.
But when reporters ask the minister, he deny sharp-sharp like uncle dodging bill. He called Zainab a blackmailer and say she be just “his sister’s friend.” Sister Ruth jump in like backup singer, claiming say na sick mama matter and “family friends” fund am. But when dem request small proof, she say the woman wey link them don kpai. Just like that, evidence vanish like jollof for Owambe.
But Zainab no gree at all. She say all the denials na big cover-up. According to her, she meet Ruth only after landing Naija, and yes, everything from shady immigration to new house and government-funded soft life is 100% true.
Meanwhile, Immigration dey silent like NEPA during thunderstorm. For country wey dey shout “corruption” like national anthem, this one no just smell, e rotten like armpit after night vigil with no fan. Na full-blown comedy skit we dey watch, with high budget and premium disgrace.
Holy secrets and bedroom confession: Nollywood actress exposes pastor
Just as the aviation scandal gist still dey hang like leftover smoke, Doris Ogala burst into the chat like untight gen wire, with one bombshell wey shake social media like bride price negotiation. The Nollywood actress no come play, she carry one pastor’s name for mouth and drama wey fit baptize your entire timeline without warning.
Actress Doris said she had a near death experience. She talk say she enter heaven VIP lounge where angels dey serve peace like small chops and everything sweet like honeymoon buffet.
Dem don treat her like queen for paradise until spiritual bouncers tell her: “Madam, your time never reach, go back!” But instead of holy testimony, she return with fire to drag one popular man of God from altar straight to Instagram hot seat. Who send her this holy drama? Only heaven sabi!
According to Doris, she and Pastor Chris Okafor (yes o, the Mountain of Liberation founder himself) had full-blown relationship with holy hands doing unholy wonders. “We fucked everywhere,” she typed boldly like sermon. Not bedroom, not hotel, everywhere. Pastor, this one no be ordinary altar shaking. Na full blown 50 Shades of Anointing!
Doris no want hold brake. She say she practically lived in Pastor Chris Okafor’s house, even his daughters sabi her as “Daddy’s babe.” According to her, he promised marriage, but when promise start to look like cruise, she carry her dignity waka go marry another man. Marriage crash. She reconnect with Pastor, belle enter that later ended in miscarriage. But aunty say she hold receipts: chats, test results, and even naked tapes.
As Pastor dey form “just church member,” she fire back: “Which member? I never even join offering line!” Na there drama collect mic and refuse to drop.
Now Nigerians dey ask: Is this a cry for justice, spiritual cleansing, or just pure attention seeking? Some talk say she dey spill too much, others dey say she finally gather mouth to talk. Either way, internet don knock like generator wey no get oil. E no dey start, e no dey stop. Pastor Chris? The man dey silent like him dey inside witness protection. But if silence fit sweat, his own don soak shirt.
Love lost in transit
My people, if you think Nigerian mothers don retire from matchmaking, you lie! One bride-to-be just jam brake on her wedding plans like DSTV subscription wey expire mid-BBNaija eviction.
The wedding that was supposed to hold on April 22 just vanished like NEPA light. Tradition done, bride price paid, and Isaac Chijindu Victor the now ex-groom don already iron his native and practice his dance steps.
Then suddenly, the bride said, “Cancel the rice, I’m marrying visa!” Yes, babe switched groom like MTN to Glo. The guy abroad don scatter the home game without even stepping on the pitch. Na real life drama be this oo.
And guess who mastermind the whole drama? Her mama! Yes o, her very own mother. Na she introduce her pikin to one abroad bobo wey dey fling dollars like him dey dash mosquito slap. The Nigerian groom became “God when.” No fight, no cheating, just fresh Japa opportunity and wedding plans evaporate like morning dew. Shame lodge me for Eko hotel.
The matter blew up online after one Twitter user dropped the update like breaking news, with heartbreak trending and social media in-laws gathering like endless Owambe. One person called the japa boo a certified mugu. “Only first-class mumu go marry babe deep inside wedding plans,” while another dey than God say Isaac dodged a premium bullet, despite the heartbreak.
Some still haven’t recovered. One X user even vowed to DM the groom for the “full Netflix series,” and another dubbed the bride’s family “insatiable in-laws,” saying dem no dey marry, dem dey hunt sponsors!
But wait oo, how you go collect dowry, fix wedding date, rehearse dance steps, yet still keep space for Plan B? This babe run emotional double shift like person wey dey do day and night duty! Now she don fly go abroad, and poor Isaac dey one corner, hugging throw pillow and typing heartbreak epistle. My people, until rice touch plate and DJ shout “couple of the year,” no love is sure anymore. Shine ya eye!
Flirting gone wrong
Terry, one fine Warri boy wey get boldness like lion but sense like rat, don finally jam who pass am. The guy wey dey move like Facebook Casanova, waka enter big wahala after he carry himself go disturb married woman wey no send am. The woman tell am straight: “Oga, I get husband and two children o.”
But you know as some Warri boys dey do. Na married women dey sweet dem pass. Terry say na that kain challenge dey ginger him mojo. E pain me say stupidity no dey show for face.
For two weeks, this boy dey drop lines like he get am for wholesale. “I go lick your plate clean,” “I go knack you sotey your ancestors go jealous.” Na so he dey type with full chest. Sir, is it crack? Because it surely wasn’t common sense.
Unfortunately, what our lover boy didn’t know was that the woman he was serenading was the wife of one well-known bouncer in Asaba, man wey fit carry Toyota Sienna like gym weight. Yes oo, bouncer wey fit break coconut with hands.
The woman no even raise voice. She jeje carry the chats go show her husband. Baba bouncer look the message, crack finger, and say, “Reply am. Leave the rest for me.” And just like that, the bouncer activated “Operation Set Up the Mumu”. He took over the chats, all the “I miss you baby. When can we see?” Na bouncer dey type am with iron fingers.
Meanwhile, Terry dey blush like Christmas turkey, thinking say the babe don finally gree. Dem fix meet-up for one low-budget brothel in Asaba. Some people dey move with empty body, but brain no follow.
D-day land, and Loverboy Terry waka enter Asaba with Gold Circle, lotion, and confidence louder than his common sense. As he stepped into the hotel like man wey just win love jackpot, na ambush greet am. Three hefty men surround am like EFCC raid. Before he fit say “baby,” hot slap reset him mouth, another punch adjust him future. Next thing, Terry begin confess like mosquito near Baygon say he don knack people wife for Warri, Sapele, even one widow for Ughelli. Na there we know say foolishness dey wear perfume too.
Next time Terry wan open Facebook, e go first pray, sprinkle holy water, check CCTV, then gently log out. My gistlovers, no be every “hello beautiful” wey you drop for inbox dey lead to romance. Some dey lead straight to the orthopedic department with full body bandage. If person tell you say dem marry, abeg carry your toasting skills go elsewhere.
*Trending with Nancy Mbaegbu, Southerner Xtra, Sunday, May 18, 2025