By Nancy Mbaegbu
Wahala no dey ever warn before e land, and this time, na Tech Queen Sapphire wey carry am like handbag! Just as she dey form “Women in Tech” online, FBI burst her scene like surprise Rambo. Dem say our very own Chinemezu Sapphire Egemasi allegedly coded her way into $1.3 million cyber fraud. No be play o. That kind money fit bleach person skin naturally.
According to the tori wey land like hot puff-puff, Sapphire no run this Yahoo Pro Max operation alone. Dem say she dey work hand-in-laptop with Samuel Kwadwo Osei, a Ghanaian baba for fraud matters.
The guy dey base for Ghana, and na him lead the syndicate wey Sapphire serve as chief tech pilot. She reportedly helped build cloned U.S. government websites wey look so real, even Biden fit enter password there.
Through those fake portals, dem collect login details from unsuspecting officials and redirect heavy government money enter coded accounts. Just one move snatched $965,000 meant for the city of Kentucky. Plus another $330,000 wey dem redirect like WhatsApp broadcast. Na real digital heist! FBI talk say Sapphire allegedly made the tech part work.
Meanwhile, online Sapphire was doing motivational speaking with filter. She dey preach “Women in STEM,” snap with MacBook, rock designer, form boss energy. She even claimed say she interned for BP, Zara, H&M, and lived in Cambridge, UK. FBI check all, nothing like dat! All her claims dry like burnt ponmo. Even her so-called UK Cambridge address na audio!
Right now, Sapphire no dey do brunch again, na courtroom she dey report to. FBI grip her for New York and she go answer for the matter in Kentucky. If dem convict her, she fit do 20 years inside U.S. prison, with one-way ticket back to Nigeria after.
From soft life to cell life, na real life plot twist. As for her Ghanaian oga, e be like say dem still dey trace that one.
No be every tech genius wey dey quote Elon Musk and wear blazer clean o. Some dey code real apps, others dey code government money enter corner. Just shine your eye, soft life get version and not all of them legit.
Oshiomhole vs Air Peace roforofo fight
Everyday for Naija airports, the national anthem no be “Arise o compatriots” na “Flight delayed,” “Flight cancelled,” “Technical issue.” If you never cry for airport before, you never truly jam Nigeria.
But this recent gbas gbos between Comrade Adams Oshiomhole and Air Peace? E pass ordinary delay o. Na full-blown blockbuster inside Terminal B.
The wahala start when Oshiomhole, former Edo State governor turned senator with federal swagger, land Lagos airport around 6:00am to catch him 6:30am flight to Abuja. Baba don do online check-in, so him stroll in with confidence like coded VIP. Next thing, Air Peace tell am say boarding don close. Just like that. No explanation, not even cabin biscuit for consolation.
Oga Comrade shock. He para say “How plane never take off but una go tell person wey check in early say him late? Meanwhile una dey collect people money inside terminal dey resell same seat for higher price?” Airport don turn auction house?
Na there drama start. One woman with pikin begin cry say dem bounce her too. Ticket don waste. Passengers begin vex, phones come out, and Oshiomhole our people’s champion decide say today na today.
When dem realize say na Oshiomhole, one manager rush come: “Let’s rectify it, sir.” But Comrade stand gidigba: “I no want special treatment, I want justice for everybody.” Before this holy offer, staff don already tell stranded passengers say next flight go cost extra ₦109k. Na wa. Airport don turn auction house.
Na there dem twist the script. Air Peace staff claim say Oshiomhole block boarding gate and cause commotion. But Comrade deny am sharp-sharp, say he no break anything or touch anybody. Infact, he even dash one stranded mama ₦500k to buy new ticket. So who really cause wahala, helper or hustler?
Air Peace no gree. Dem drag Oshiomhole like say na him break national airport protocol handbook. Dem accuse am of “disrupting operations,” “harassing staff,” and “causing confusion.” But Oshiomhole no back down. Him reply with full chest: “I be Comrade, no be tout. I dey fight for fairness, no be free flight!”
Oshiomhole don vow say him go take the matter up with aviation authorities and escalate am to the appropriate ministry. Because according to am, “this no be my personal fight, it’s for every Nigerian wey don suffer this same nonsense in silence.”
Las las, this matter just prove say for Naija airport, even VIPs no safe from premium shege. Whether you check in or not, dem fit ghost your seat and sell am to the highest bidder.
When groove turns grief
My people, who go believe say ordinary girls’ night out for Port Harcourt go end like Mortal Kombat? Three babes step into Black Box, one of the buzzing clubs for PH with good vibes on their minds. Table booked. Drinks on deck. Groove activated. But by the end of the night, na blood, missing tooth, and one wig still missing in action.
According to one of the ladies, as gbedu enter body and dance dey sweet, person hit her friend phone and barked, “Why you dey make video of me?” The friend replied, “Oh no, I’m not videoing you,” and turned to adjust. Only for dem to notice say the same man was comfortably sitting on their reserved table space like say na presidential seat.
When the girl politely told him the seat was booked, oga explode: “Why are you sitting and I’m standing? If you get mind, come siddon here!” He even started pushing her friend like say na action movie. When the third girl asked why he was shoving her friend, GBOAA! Bottle landed on her head. Just like that.
From there, everywhere burst. Another girl collect heavy punch and her tooth vanished instantly. And the third babe? Dragged like sack of rice, beaten and stripped naked by the man’s security guard there in public. Inside a whole club! People start to dey record, some dey shout, but nobody fit stop the madness. Bouncers just stand like flowerpot wey dem use decorate the club.
The alleged attacker? One Maduba Christian Okechi, owner of Ceemore Tiles. Social media no gree. Nigerians entered full dragging mode. Twitter, TikTok, IG, everybody carry the matter for head like gala. Lawyers dropped hot takes and angry citizens began to demand names, arrests, and shutdown.
It didn’t help when one of the girls revealed say this wasn’t the first time. According to her, “That man don beat person for this same club before and nothing happened!” So the guy na serial assaulter and dem still dey allow am stroll in like VIP? Una dey whine us?
That’s when the club owner crawled out with one press release. To be fair, he didn’t defend nonsense. He confirmed say the girls actually reserved the table, and the attack happened after they refused to give it up. He condemned the violence, said dem dey work with security, and promised to assist the victims.
But Nigerians no dey hear “we’re investigating” again. That line don expire. Because how girls go chop punch, bottle, and premium disgrace inside your business and una still dey drop grammar? Na so online lawyers begin drag the owner left and right, saying this could’ve ended in death.
Now, the babes dey demand real justice. Not online clout o, real arrest, real accountability, and maybe small compensation to fix the trauma and torn wigs. Because if girls no fit party in peace again, then wetin remain for soft life?
Stay glued, because this gist still dey hot and we never hear the last of it. PH wahala no just wear high heel, e carry clutch bag.
Abortion through Cappuccino
My people, wonders no dey ever finish o! Just when we think we’ve heard it all, one man for Texas don carry relationship wahala enter full-blown criminal case. Meet Justin Anthony Banta, IT staff by day, alleged evil schemer by night.
The whole gist start like romantic wahala. Babe tell her man say she don carry belle, normal level. Instead of small joy or at least pretending to be happy, oga Justin begin suggest abortion like say na lunch menu. But babe stand gidigba, tell am say she go keep the baby.
Instead of facing fatherhood like man, Banta decide to switch gear from boyfriend, to pharmacist with evil intentions.
One fateful day, Banta and madam meet up for coffee, innocent outing abi? She collect her drink, sip with love, but na Plan C wey dey inside the cup! Before she reach house finish, bleeding don start like horror film. Fear catch her. She run go hospital, only to hear say baby don go. Omo, her heart break like Naira under inflation.
Her spirit no rest, but the real gbege start when she tell police say she dey suspect foul play, and she strongly believe say na that drink wey he give am do the damage.
Dem open investigation, drag Banta go question room. When police seize him phone to gather evidence, guess wetin happen? Data don vanish, evidence don waka. Detectives talk say the man use remote reset clear everything like say na spy gadget dem dey use. You dey see criminal with sense?
Authorities no gree. Dem slap am with capital murder and evidence tampering charges. And the funniest part? The guy dey work for U.S. Department of Justice. Yes o! The man wey suppose uphold law dey inside court for breaking it. Irony wan suffocate person.
As the matter dey unfold, Texas authorities no dey play at all, especially with their strict abortion laws. Meanwhile, girls all over dey hold their drinks tight because trust these days na scarce commodity.
But my people, why some men go chop responsibility like chewing gum but spit am out when e reach time to man up? Banta, for just ghost her if him no ready for papa duties. No be every problem dem dey solve with chemistry.
*Southerner Xtra
Trending with Nancy Mbaegbu
Sunday, June 22, 2025