By Nancy Mbaegbu
Sextortion: Benue girls expose Governor’s aide
Wetin dey really happen for Nigeria, ehn? Na every week we dey wake up to fresh episodes of Government Oficials Gone Wild.
This time, na Dr. Mkor Aondona, Governor Hyacinth Alia’s Special Adviser on Documentation, Research and Planning wey don land inside EFCC net. But no be for chop money matter o. Na for something wey sound like Sex for Role for Campus Chronicles. You dey confuse? Make I gist you wella.
According to EFCC tori, bros wey suppose dey plan research for Benue State dey plan different kind research wey involve bedmatics and small small girls.
Him pattern? He go recruit slim and fine babes under the guise of “ushering jobs”. You know those jobs wey require fine face and killer smile. But before you enter shortlist? You go enter his bed first. Na the “do before duty” method, and e no end there o!
The wahala come burst when the girls begin yarn say after the coded mattress interview, oga adviser go secretly dey record everything without their knowledge. Imagine say you think you just go knack for opportunity, only to find out say your knacking don turn season film wey you no even get script for.
And when you talk say you no do again, na then bros go show you teaser from Episode One and threaten to release am. Talk about wickedness with extra hot pepper sauce!
EFCC para enter the matter sharp sharp after plenty petitions roll in from some tertiary students wey don tire to dey live in fear of their own nudes getting into the internet.
The man no just record dem o, he allegedly dey share the tapes through messaging apps like say na Netflix subscription. You fit just dey your corner, dey scroll softly for Instagram, next thing na yourself you go see dey do backstroke for your neighbor’s phone like Olympic swimmer.
Now EFCC don carry am go cool off for detention. As investigation dey go, e clear say this matter no be “alleged” again, na almost documentary series. Benue State asked for documentation, and dem received sex tape catalogue.
Abeg my loves, no be every ushering job wey get “connection” mean say you don hammer, sometimes, na full-blown scandal you dey enter o.
How OOU turned exam hall to bra inspection center
My people, e be like say for Olabisi Onabanjo University (OOU), Ago-Iwoye, na lingerie matter go determine who pass exam. As in, forget expo, na underwire dem dey chase now.
On Tuesday, a video land online wey show female students queue like say na rice dem wan collect, but instead of JAMB slip, dem dey use chest dey mark attendance. Why? Because some officials who nobody sabi dey check if dem wear bra before dem fit enter CBT hall. You read am well. Bra-check before brain-check!
The gist long reach say the so-called exam marshals were allegedly pressing breast like say dem dey do BP test. Girls stand one by one, some dey adjust cloth, others dey argue, but the inspectors no gree.
If your chest no rise like mountain, you fit miss exam. Internet catch fire immediately, X (formerly Twitter) and IG dey boil like Indomie water. Everybody dey ask: “Since when bra become WAEC requirement?”
OOU Student Union president, Muizz Olatunji, try defend the madness. Him say na old rule wey dey prevent “distractions” for exam hall. Distraction, ke? So na female students’ nipples dey affect CBT server now? And who decide say tight bra go boost brain power? Abi na new type of biometric authentication?
Angry students, feminists, and online warriors don vex. People shout say the inspection na sexual assault on a budget. One human rights lawyer even talk say if person touch you anyhow for that kind setting, e fit land them for court. Meanwhile, some girls swear say after that humiliation, dem no fit think straight again. Forget CBT, dem own na PTSD.
Till now, the university never drop official statement. Them dey do like say e no concern dem. But gist be say the matter no dey cool anytime soon. Nigeria wey suppose dey tackle exam malpractice, na woman bra dem carry for head like gala.
So as e be now, make everybody shine eye oo because in OOU, no be only knowledge dem dey check. If you no strap up, you no step in. You wan pass exam? Better wear full gear because apparently, Victoria Secret na the new passcode.
Welcome to Nigeria, where exam dey start from your chest before it reach your head.
Final goodbye for Shimite Bello
Tears full ground. Real ones. From people wey know her, and even those wey just dey hear her story for the first time. Early morning for Ebu community, Delta State, the atmosphere heavy as Shimite Bello’s white casket enter her father’s compound. Na final rest be this, but the wahala wey follow her death still dey raise eyebrow like say na season film wey never finish.
People gather, quiet but full of emotion. Her close friends dey cry like small pikin, her family just dey look ground like say if dem talk, dam go burst. The burial no loud, but the silence loud pass grenade People dey whisper, “This one no clear o, this girl wey dey full of life just go like that?”
Shimite’s death didn’t come with the kind of peace that helps people grieve and move on. Truth be say, up till now, nobody sabi wetin really happen. Dem talk say she collapse. Another person talk say she bin get health issues. Then boom, people start to point finger. Na her husband kill am. Na emotional abuse. Dem say she wan leave the marriage.
Some people even claim say she confide in dem say she no dey happy. But why nobody talk all these things when she dey alive?
And the husband matter? Hmmm. That one na full episode on its own. His silence choke pass tight hug from a bitter ex. He no come online, no drop statement, nothing.
E reach to ask; why dem rush do burial? Why body no stay hospital for small autopsy? Why everybody dey dodge this matter like say na bomb? Something dey hide under this wrapper.
Now, Shimite don finally rest. She dey under the ground, but the truth still dey hang for air like stubborn breeze wey no wan blow finish. The questions full like rice for wedding cooler. This matter never end. And until answers show face, we go continue to ask: what really happened to Shimite Bello?
NYSC extends Raye’s service year
Wetin dey happen for this country sef? Just when everybody thought the Raye vs NYSC saga don cool like ice block, boom, plot twist land like movie series, season two.
Rita Ushie aka Raye, the Instagram baddie wey trend in April for dragging Tinubu’s economic policies, don receive official sapa extension!! Sorry, we mean NYSC service year extension. Two whole months added to her khaki journey because she get the boldness to yarn her mind about how cost of living dey suffocate Nigerians.
If you remember the first episode, na one video wey she post, lamenting how cost of living wan kpai the living, wey cause this wahala. Instead of clapping for her honesty, NYSC officials vex say she drag dem into political mess.
Dem threaten, dem ghost her at the first disciplinary hearing, even when activist Omoyele Sowore carry human rights backup reach camp. But now? NYSC don finally show face, and Raye don collect panel invite like wedding IV.
According to gist from Jonathan Ugbal of Take It Back Movement, Raye go camp, talk her own, and even apologize to the NYSC staff wey catch emotional fever over social media dragging.
But instead of “go and sin no more,” dem gift her two more months inside khaki. Omo, her Mama even call Ugbal in tears, say her daughter dey cry for phone like person wey dem cancel her visa.
Social media don scatter again. Nigerians dey ask, “So person no fit talk again for this country?” Others dey shout say the punishment too harsh, say na pure oppression with federal backing. As for NYSC, dem still dey maintain radio silence like say na drama wey dem no write script for.
But as e be, make nobody lie, this extension na coded warning to other corps members: if you talk pass your mouth, NYSC fit turn to full-time job. From youth service to silence service. Nigeria, we hail thee!
*Southerner Xtra
Trending with Nancy Mbaegbu
Sunday, July 6, 2025