DAVIDO, BILLIONAIRE DAD, ALLEGED DAUGHTER, DNA SAGA ESCALATES

By Nancy Mbaegbu

Wonders no dey end for Naija oh! We just dey start 2026 but gbege don show for social media again. This time na Anu Adeleke, wey people dey claim say na Davido teen daughter. She carry heartfelt letter pwey fit make anybody shake head post online.

For the letter, Anu talk say she don dey bullied since she small, talk how classmates dey laugh anytime she talk say her papa na David Adeleke. She say she even dey see doctor to protect her mental health. Yet, despite all the wahala, she still dey on top her class, to become Head Girl.

Now, as she don grow into young woman, she say she wan know her real identity, settle this matter once and for all. She come beg Davido make dem run DNA test, make e clear say na she choose “between me and my papa”.

Davido wey don vex tire finally reply, “After 5 DNA tests? She dey craze. She and her mom better leave me the fuck alone and go find her papa.”

Another person ask if him sabi the mama, him reply: “Never met the bitch. Except when I went for the DNA tests. Very stupid behavior.” But Davido come add say him pick three hospitals, dem pick two and, all turned out negative, and this na the last time him dey talk about this wahala.

But Anu mama, Ayo Labinjo, no gree. She fire back like proper Naija mama wey no dey joke. She insist say she no be prostitute and recount how she meet Davido in February 2013 for Dami Duro concert after-party for Ibadan, where she dey work as waitress. No be street pick-up. According to her, Davido no even get money like now then; she only sabi am as upcoming singer and son of a businessman.

Ayo stress say she dey protect her daughter mental health, claiming say Anu dey cry, faint for school, and don dey see psychologist since she small. She also allege say a so-called DNA test in 2014 damaged Anu’s mental health after the lab allegedly discarded the blood sample and masked the result. According to her, Anu dey fight for identity, not fame or money.

Ayo still drop heavier allegations, claiming Davido chatted Anu directly, threatening to lock her up, insulting her and bullying her repeatedly. She say the language used no get excuse. Ayo also remind Davido say Anu no beg to be born. She add say since Davido be US citizen, she go formally request the US State Department make dem supervise independent DNA test through the US Embassy in Lagos or Abuja.

Then DaddyFreeze enter scene, carry more drama. Him claim say based on one of the DNA results wey him see, “David no be Anu papa.” Social media scatter, debate reignite about celebrity responsibility, online bullying, and how children dey suffer from adult wahala.

Anu mama no gree with Daddy Freeze at all. She accuse am of laundering Davido image instead of pushing for a truly independent DNA test. She allege say Davido don secretly send money to Anu before and even claim say a video call from Davido number show during his #5Alive concert in Ibadan.

Then the plot come twist small. Davido’s billionaire father, Dr. Deji Adeleke, finally stepped in publicly. According to him, five different DNA tests don already happen; three involving Davido and two involving his cousin, B-Red and all returned negative.

He explained say he cannot release Davido’s DNA profile for security and legal reasons, neither will he share the child’s profile because she be minor. Him insist say when Davido first see Anu, Davido say he had never seen the girl before but still agreed to do the test.

Dr. Adeleke still reveal say, despite knowing Anu no be his granddaughter, him don dey pay her school fees for years and even give Anu mama scholarship for him university, plus ₦50,000 every month for upkeep; all na out of compassion, according to him. Him add say now, the family dey reason legal action.

On top of that, Dr. Adeleke allege say the controversial social media account pushing Anu’s narrative is run by Kemi Olunloyo, person wey the Adeleke family claim say dem cut ties with years ago. He even read out a letter allegedly written by one of Anu’s mother’s relatives, apologising and distancing the family from the account.

But Ayo no back down. In a strongly worded response, she accused Dr. Adeleke of intimidation and abuse of power, denying say any additional DNA tests happened in 2020, and rejected claims that Kemi Olunloyo dey control Anu’s account. She insist say Davido suppose speak for himself, not hide behind his father, and warn say she go hold the family responsible if anything serious happen to her, Anu, or her mom.

At this point, Naija social media don fully scatter. Compassion dey fight receipts. With talk of lawsuits and both sides dey stand ten toes down. This one don pass regular celebrity gist, na full-blown family drama wey dey play out online.

Question now no be who dey talk loudest, but who get the final proof. Until then, this saga remains unfinished business and as usual, naija dey watch.

Regina, Ned & abortion scandal

When we think say we don finally close Regina Daniels and Senator Ned Nwoko series, Regina show face throw shade wey go make anybody sweat for social media.

She come online yan say her bestie, Ms Izuegbu Anthonet, also known as Ann, don land for police hand for theft and according to her, na Ned dey behind all this gbege.

Regina para small, dey fear for Ann safety because everything no dey follow law properly. According to her, she no fit gree say domestic wahala don suddenly turn drug palava. Now, na theft dem dey talk? She yan say Ned dey call Ann “tiny devilish Ann” before, accuse am of being drug supplier, and now after she clear that matter, this kind wahala show face. E shock people well well!

But Ned Nwoko media team no dey carry last. Dem release statement wey clear the gist like fresh pepper. Dem talk say make we forget everything wey dey trend for social media about the arrest, the real reason Ann land police hand na criminal defamation.

According to them, she publicly claim say Ned physically beat his wife Laila Nwoko, wey supposedly cause miscarriage but according to them, na lie! Dem talk say no assault happened, no miscarriage happened, everything na part of coordinated plan to twist domestic violence story.

Dem still yan say Ann dey implicated in procurement of illegal abortion for Regina during her marriage to Ned. According to police statement, Ann caused Regina to swallow plenty controlled substances wey make her dey bleed for weeks.

The case don enter official witness statement submitted to the Area Commander, Maitama Police Station, since 29th October 2025; detailing Ann’s ongoing activities, suppliers, and other people wey dey implicated. Social media scatter; everybody dey para, dey gasp.

Regina self no gree. She fire back like proper queen, dey question why Ned still dey play with her life when him don already live sweet life. She even called the whole wahala “social media entertainment” dey ask “to what end?” This one pass gist, na full blockbuster!

Now, everything dey under proper law enforcement investigation, but the tea dey hot well well. This na real-life drama wey get betrayal, secrets, and shade bundled together. The suspense dey high, and the whole country dey wait see who go collapse first — Regina or Ned?

South African strippers spill Naija secrets on live podcast

Omoooo, Naija social media don scatter again! Two South African strippers just yan their wahala and their money moves for Nedu Wazobia Clarity Zone podcast, and omo… this gist go make your jaw drop at once !

One of the ladies yan how she started dancing after she waka come Naija, because the pay for her old job as radio presenter for South Africa no even touch wetin dancers dey make here. Na so she decide to switch lane, because Naija money na Naija money oh!

But na the second guest come make people fall from chair: she talk say her daily earnings dey around N2.5 million to N3 million, and she describe that one as her “least” take-home on some days. Omo, social media freeze, people begin dey calculate, dey cry, dey shout: “Na wah oo! who go fit collect money like this?”

Then the gist enter parenting. Both ladies get nine-year-old pikin. But the way dem dey handle am na totally different movie. One yan say her son sabi wetin she dey do after him accidentally see one video for her phone, while the other yan say her daughter no sabi anything. “Chai, parenting level na full Naija movie oo!”

Abi una think say na only big boys or sugar daddies dey patronize them? Wait till you hear this: dem yan say clients dey everywhere, from big oga dem wey sabi life, even pastors sef dey follow for their customer list. Na so social media shatter! People dey calculate sermon money vs dance hall money, dey shout: “Omo, pastor sef dey patronize strippers?” True true, Naija no dey carry last.

As the podcast dey trend now, social media don divide. Some dey hail the hustle: “Money na money, abi wetin?” Others dey wag finger: “Ah ah, no be small thing oo!” But one thing clear, money dey, drama dey, parenting wahala dey, and the gist go scatter your brain.

*Southerner Xtra
Trending with Nancy Mbaegbu

Related posts

Leave a Comment