By Nancy Mbaegbu
My gistlovers, this life no balance at all! Na who we offend wey everyday na one hot scandal dey fly for Nigeria? See this particular Auchi Polytechnic gist ehn, the plot twist fit give Nollywood headache.
E start like normal “lecturer caught pants down with married woman” story, but as e dey go, we come dey wonder if na lecture or Netflix series we dey watch!
Dem first yarn say one lecturer for Federal Poly Auchi, wey him name na Mr. Ehighie, waka enter another man matrimonial bedvgo chop forbidden fruit. Wetin concern him with married nursing mother, only God know! Dem say na sex-for-mark plus adultery packaged together.
Wahala burst when the woman husband and some area boys burst in, video scatter everywhere, with lecturer naked, and the man dey cry like say dem thief him destiny. Social media no gree rest!
But before we fit shout “awon sex for grade association”, another angle enter! Dem say no be sex-for-mark o, say na cultist setup! Report come talk say the lecturer offend some cult boys before, say him no gree allow dem force student join cult.
As per stubborn man, cult boys vex, arrange blackmail. Dem lure am with fake “water supply” issue, lock door, strip am naked, even force am do abominable things on camera. Omo! From fornication scandal to cult attack, na only God fit separate truth from lie here!
But wait! E never end o. The third angle even sweet pass zobo. The married woman herself release voice note say na her husband and vigilantes set the lecturer up.
According to her, lecturer wey dey help them pump water before, start dey chase her up and down like say na bride price he wan pay. She report am to her husband but oga no gree take am serious. Later, she show am their chat. Omo, husband vex.
Dem plan full operation. She lure lecturer come house, tell am say husband travel. Lecturer cancel class sharply, rush go. Baba no waste them, he don yank off him clothes. Na there husband burst in with vigilantes, and wahala burst everywhere.
Now, everybody dey ask; na cultists really set am up? Abi na true say na husband and wife arrange trap to catch lecturer wey no fit zip up? Or maybe, just maybe this lecturer na real ogbonge sugar daddy wey waka enter him own doom with full chest?
Social media don divide like Moses part Red Sea. Some dey clap for the husband, others dey shout say na setup and wickedness of the highest order. Meanwhile, Auchi Polytechnic authorities still dey do silent mode, dem never talk anything!
But honestly, my people, make we no lie, this matter don turn gbas gbos of confusion. We sef don lost inside the story because every angle get him own convincing version.
One minute na adultery, next minute na cult wahala, then even husband and wife set-up enter the mix. Abeg, who we go believe like this? Na only God fit judge this one because for this life ehn, wahala no dey ever finish and Naija gist dey sweet but e dey twist. Omo, we go just dey look dey sip zobo till final gist drop.
Short time turns to paralysis after one round
My people, this gist wey land hot like freshly baked meat pie. Imagine cruising into hotel with side chic, but instead of enjoying the forbidden fruit in peace, na ambulance carry you commot! Na wetin happen to one 43 years old man wey dem identify as Rafiu Lasisi inside Abeokuta, Ogun state be dat.
Oga Rafiu, wey suppose dey house mind him business, reportedly carry him concubine, one married mama of three, Latifat Shobowale, enter Winnas Hotel and Suites for Arigbajo area. The plan na “short-time” coded style. But oh boy, after just one round, everything scatter!
According to police tori, wahala start immediately after dem finish their coded marathon. Latifat begin shout like person wey see ghost say Rafiu no fit stand up again. Baba’s left hand and leg don go on strike; paralysis, just like that! You dey imagine am? From short time to hospital stretcher in under 30 minutes!
Hotel owner, wey also double as Eze Ndigbo of the area, sharply report the matter to police. Detectives rush reach scene, carry the paralysed Romeo go state hospital, where dem just manage stabilise am before referring him to FMC Abeokuta for better treatment. As for Madam Latifat, dem no waste time; na straight to police station for questioning.
Now everybody dey wonder, wetin really cause this sudden paralysis? Village people? Over-excitement? Juju from the woman’s husband? Or na spiritual backhand for trying to break a home?
As investigation dey go on, social media don scatter with theories! Some people talk say, “Na punishment for nacking person wife.” Others say, “E fit be high blood pressure wey catch am unawares.”
As e be now, Rafiu dey hospital dey battle for him body revival, while Latifat dey police net dey explain how “ordinary one round” nearly turn to obituary announcement. Abeg, no be everything wey sweet for eye dey sweet for body o.
Tuface and the one-woman scandal
My sister, if dem ever tell you say microphone no dey fear anybody, believe am. Because na so Tuface Idibia carry him legendary self enter podcast, sit down with confidence like person wey no dey expect wahala, and drop one line wey scatter everywhere: “Men are not wired for one woman.”
Baba talk am with his full chest. According to him, man fit love woman genuinely but when it comes to konji matter, him “biology” fit push am go off track. In short, love no dey cancel wandering waistline. E just dey decorate am.
Before person fit say “African Queen,” social media don scatter! Twitter catch fire, Instagram drag begin, and even Facebook aunties dust Bible join. People begin remind am say this no be the first time he dey talk like say monogamy na punishment.
Because guess what? This same Tuface, back when he still dey with Annie Idibia, dropped similar nonsense on Young, Famous & African the Netflix reality show. The man looked Annie dead in the eye and said,“A man can love a woman and still cheat on her.”
Annie nearly evaporate on camera. Internet people no let am rest that time, and now dem say, “E don carry the same line go podcast. E just change mic, but na the same script.”
To make am worse, e never too tey wey he announce divorce from Annie and link up with Natasha Osawuru. So when he now repeat that same talk on podcast, people shout, “We’ve heard this episode before!” But this one loud pass speaker for naming ceremony.
As backlash begin fly like witch for night bus, Baba know say e don go too far. Na so he rush drop apology video. Him face be like person wey mistakenly reply group chat with romantic voice note. He talk say his words no land well, say he no try disrespect women.
He apologized to Natasha. Yes oh! Natasha wey be him new babe after Annie. Baba say sorry for dragging her into unnecessary heat.
Internet people screamed, “EHN?! So Tuface know how to say sorry?!” One person tweet, “Something he never did for Annie even after she fight baby mamas like Avengers.” Another wrote, “This man dey play apology like SIM card one per era.”
But apology or not, Nigerians no let am rest. One babe for TikTok say, “Oga, this is not a podcast, it’s a confession.” Another shout, “Why is it always you?!”
Las las, podcast no be for everybody. Because once you carry mic talk say “men are not wired for one woman,” just know say apology video go follow like DSTV reminder.
PH babe narrowly escapes death by sponsor
Na who dey drag woman matter like gala for hold-up? One beautiful babe for Port Harcourt just survive the kind horror wey fit make movie director retire. Her only crime? She told one man “I no do again.” And the man Tamunotomba Barango replied with, “You go die for here.”
Gist be say dem meet during JAMB season. She be young girl trying to find her path. Him be “sponsor” with plenty promises. Seven whole years, baba dey send her to school, support her family, do everything.
But wetin him dey hide? Wife and four children! Like play, like joke, lover girl finds out. And she, with her full chest, say, “I no fit be second wife, I no do again.” That’s when the demon inside bros wake up.
He started to threaten her, chase off any new man wey show interest. Then one day, he called her for “peaceful breakup.” Say make dem part like mature people. Biggest mistake.
Na so she go see bros. Baba dey dance, drink Gordon’s like say dem dash am angel wings. She say she get ulcer, he force her to drink. Still, she hold herself.
By 10pm, he say make him drop her. Na that “drop” almost drop her into grave. Baba take strange route. Next thing she hear; clack clack. Bros cock gun! Gun jammed. Devil no dey rest.
He grabbed Gordon’s bottle, break am on her head, begin stab her face, hand, yansh, like say she be thief. The man dey shout, “So another man go enjoy this your fine body after all my money?”
Thank God she escaped by rolling out of the moving car. Yes, real-life stunt! He reversed to crush her, but she kept rolling till Good Samaritans show. She’s now in the hospital, stitched, battered,. Six pints of blood gone, but she’s alive!
And as usual, Nigerians begin drop hot takes “Don’t sponsor women,” “She used him,” and one person even ask, “How you go date man for 7 years and no know say he don marry?” Like say manipulation no dey, like say men no sabi live double life with full acting script.
Let’s be real, Sponsorship no be ownership. And Ladies, abeg, stop going for “closure meetings.” Some men no dey seek peace, dem dey plan obituary.
*Southerner Xtra
Trending with Nancy Mbaegbu
Sunday, July 13, 2025
