By Nancy Mbaegbu Naija pastors no dey carry last. Just when you think say dem go dey preach only, one pastor turn Lagos traffic to Nollywood thriller. E shock everybody. So the gist be say, one content creator wey dey film luxury cars for Lagos jam Pastor Paul Adefarasin’s Range Rover for traffic. As baba spot the guy with camera, he sharply wind down window like say he wan drop offering. Next thing? Pastor allegedly flash something wey resemble firearm. The content creator freeze like NEPA give him body shock.…
Read More