ENUGU BILLIONAIRE IN RITUAL SCANDAL

By Nancy Mbaegbu

Aprokonation, this one no be mild gist ooo. E choke like gossip wey dey fly for market. One so-called billionaire native doctor from Enugu, High Chief Levi Onyeka Obu, aka Ezeani don turn small village upside down after people say dem catch am trying to bury a 13-year-old girl alive. Wait first. Alive o. People say the girl still dey breathe when dem drag her out.

Dem no finish shout when villagers say dem begin dig around the compound. What did they find? Multiple dead bodies, including that of a heavily pregnant woman.You hear am well. This no be prank.

Inside that same property, women, young girls, decomposing bodies, all chilling underground like say dem dey one unholy museum. Yet, this man dey drive tinted jeep, dey live for one estate-like mansion. Who would’ve thought?

Governor Peter Mbah no waste time. He ordered instant demolition of all the man’s properties, including the one wey be like palace-in-progress.

Meanwhile, as Enugu youths hear the full gist, dem no wait for government. Dem vex enter riot mode; burn em mansion, scatter compound, and swear say the girl dem rescue go get justice. One boy even shout, “Na our sisters dey disappear since! Today, we don catch the root!”

Now, Ezeani don dey police custody after Immigration catch am for Seme border like thief wey miss road. Man was on the run like say EFCC dey play hide and seek. No luggage, no shame, just raw panic.

But the plot twist sweet pass Afang soup. Instead of fear, Chief Ezeani begin do interview inside police cell, with confidence wey pass politician own. He talk say na pure setup, that he’s innocent and just a humble okrika businessman.

According to him, the bodies were “planted” by village people wey no want make him ascend throne as next king. Ah. Kingship? So na royal beef cause this burial buffet? Na only time and evidence go talk true.

As we speak, Ezeani still dey custody, while the whole community still dey recover from the shock. This na the type of scandal wey go make you start side-eyeing rich uncles wey no dey explain their source of wealth well.

A daughter’s deadly accusation

My people gather here o, because what just happened on social media no be gist we fit talk small small. This one na full-blown spiritual gbas-gbos with family drama, power play, and one kain thunderous allegation that left everybody shouting “Blood of Ezekiel!”

Jane Edidiong Ufot, the first daughter of Akwa Ibom State Governor Umo Eno, don carry her ring light, her iPhone, and her full chest enter the battlefield of Instagram to drag her papa with no mercy. The same papa wey appoint her Senior Special Adviser on Health, Safety and Environment. Well, she say e don pass advice. She no dey safe again!

With voice shaking and eyes blazing like person wey don soak inside midnight vigil, Jane declared: “I’m not a sacrifice! Mummy was, but I’m not!” Blood of Nebuchadnezzar! Governor ke? Sacrifice ke? Na there everybody shout “Awoooon! Ritual don enter government house?”

Before we fit say “Jehovah!”, she hand her phone to her small daughter to ask her grandpa the question of the century “Do you want them to kill us? Do you want us to die like my baby brother died?” Omo! TikTok freeze. Twitter (sorry, X) catch fire. Instagram began to upload like say MTN dey stress.

Governor Eno no say pim during the call. The silence loud. As in, the kind silence wey go make even native doctor fear say e don enter spiritual zone. And Jane warn say if anything touch her or her child, make we know say blood no go waste. If prayer warriors no gather after that kind statement, make dem return their anointing oil.

But calm down, Governor Umo Eno don finally break silence. According to him, that video no be recent one. E happen shortly after his wife died in 2024. He say the poor girl (Jane) was grieving, and some “detractors” just dig am up to trend before his second anniversary in office. As per, “My family is intact.”

Government drop statement, say Jane was misled by false prophets and her emotional outburst has now been turned to political pepper soup. Dem beg Nigerians to rest the matter and let the late First Lady rest in peace.

But sha, the streets never forget. And as e be now, even with the governor’s calm PR, Jane’s firestorm don already ignite spiritual suspicion and political side-eye. Whether truth or trauma, na only time go tell.

Cosa Nostra in the mud

If you think Lagos nightlife na just bottles, soft music, and blue light aesthetics, think again o! One babe entered Cosa Nostra, the flashy club owned by footballer Emmanuel Emenike, to flex her fine girl energy.

But instead of enjoyment, na Royal Rumble she jam. She left with bruises, dignity in shambles, and a wig that didn’t make it out alive. Who send her? Nightlife wey suppose be cruise turned WWE.

According to madam victim, she just dey dance her dance, sip her drink, and enjoy soft life, when someone suddenly pushed her. She say she fall small, and when she vex react as per, “Don’t try me” energy, na there gbege start. Before she fit complete her sentence, bouncers don land.

She say dem no ask question. Dem just pounce on her like she be stolen phone. Next thing, she dey ground. They dragged her like person wey do short time, and no agree to pay. Body scratch, wig shift, lashes detach. As she talk am online, “Na for standing up for myself dem beat me.” And boom, Nigerians switch to rage mode.

Instagram people no waste time. Where’s Emenike?” “Shut that club down!” “This is barbaric!” Twitter children typed with fire and thunder. Nigerians gathered like family meeting. Even people wey never go club before begin drag the club like dead gen.

As pressure heat up, Cosa Nostra drop CCTV footage as their own receipt. Dem talk say the babe no be angel, na her wahala cause the “intervention.” But Nigerians wey don turn digital FBI, watch am frame by frame and still scream, “Lies! This video no clear!”

Now, police don carry the matter like hot puff-puff. Investigation dey on, Emenike keep quiet like say he no get data. But Nigerians? Dem don already judge am for group chat. His silence dey loud like speaker wey blow.

From epilepsy to sex scandal

Wonders shall never end in this our content-creating generation! One minute you’re loving your husband in private, next minute your kerewa video dey trend on social media like Grammy nomination.

Madam Chinasa Odika no gree keep quiet again after her dear husband leaked their sex tape to punish her, she say “Enough is enough!” and opened full marriage chapter for public viewing.

According to her, the tape was for personal pleasure. Small memory to spice up her lonely nights. But pikin wey no dey mind business jam the video carry am go show papa like assignment. As oga see am, he vex enter tech mode and upload am for the whole nation to download.

As people dey ask why oga go disgrace his own wife like that, Chinasa begin explain say the man dey vex since she “told people” he get epilepsy. Na there the drama begin.

She talk say one fateful afternoon two months ago, she returned home and met oga by the gate. She greeted him like normal wife. As she wan drop bag, oga begin shake like disco light. Before him body land ground, she catch am like say she be emergency nurse wey miss her calling.

She clean am up, wash am down, even change him cloth with love and tears. E no easy, but she manage everything until their kids Chibuike and Ujunwa came home and helped lay him gently like Easter goat.

That night she called her brother to say, “Help me thank God oh, my husband for don die!” Na that harmless talk scatter her destiny.

Next day, instead of “thank you thank you my wife,” oga land her one hot push. Her face use bamboo do face-to-face meeting. Scar still dey there like souvenir. The man talk say she dey call her boyfriends to tell dem say he get epilepsy. But Chinasa swear say she no even sabi say the man get that kind condition before she marry am. Na serious surprise package she get after wedding.

Now, she dey face double wahala, one from epilepsy palava, the other from private bedroom scenes wey don turn national content. Marriage wey start by accident, don end in public disgrace. Na only God go judge this matter.

*Southerner Xtra
Trending with Nancy Mbaegbu
Sunday, June 8, 2025

Related posts

Leave a Comment