DORIS OGALA, PASTOR OKAFOR IN HOT TANGO

By Nancy Mbaegbu

Doris Ogala, Pastor Okafor in hot tango

Once again, Nigeria wake up to one of those stories where prayer house and Instagram captions collide like danfo for Ojuelegba.

Actress Doris Ogala enter timeline with trembling voice, red eyes, and a basket full of allegations against Pastor Chris Okafor, founder and senior pastor of Grace Nation International aka liberation city. From secret romance to heartbreak deluxe.

According to her, what started as sweet love slowly turned bitter. Promises start to disappear one by one, and just when she dey think say marriage don almost knock, she allegedly discover say oga pastor don shift attention go another woman. Internet pause first, then asked: “Ah. Na so the story end?”

Before anybody fit even digest the first video wey she rekease, screenshots begin rain like August drizzle. Chats. Sweet words. Transaction receipts wey carry ₦700k like exhibit A surface. Doris ask one question wey shake everywhere: “After all this history, who you wan leave me for?” At that point, social media sit down properly, adjust chair, order popcorn and crossed legs. Because this gist pass casual scrolling.

Just when people think say next move go be press release, sermon take over the mic. Pastor Chris, no call name, but from altar him throw verbal stone enter glass house. He talked about arrogance, entitlement, and women wey dey shout say dem no dey respect anybody.

Him even add say men no dey line up to marry people with too many bedroom CVs. The sermon fly enter internet, and Nigerians reply am with raised brows: “Sir so who be the men she don sleep with, you dey exempt yourself?”

As drama dey ferment, another character enter stage. A man claiming close ties to Doris’ former husband. According to am, madam marry in 2019, marriage no produce children, and allegedly crash-landed after pastor allegedly enter the picture.

Him say she leave marriage with bitter stories, hoping say new relationship go end with ring. Social media split into factions immediately: team karma, team sympathy, team everybody-get-blame, and team mind-your-business -but-still-comment.

Next thing, hospital reports surface. Videos showing Doris weak, bandaged, talking about not wanting to be here tomorrow. Crew pause briefly. Even hardened online judges clear throat. Beneath sarcasm and dragging, people begin ask for support, counselling, and intervention while still analysing with one eye, because na Naija we dey.

Just when Nigerians think say the matter don cool, Doris return again, this time with lawyer energy. In a live conversation with Daddy Freeze, she confirm say she dey ready to take legal action.

According to her, this no be just heartbreak anymore, na promise allegedly broken and she dey ready to pursue am legally. She even addressed questions about her past marriage, admitting that while she was still married, she engaged in phone intimacy with Pastor Chris, something she say she’s not proud of, but insist say nothing physical happened then.

She claim say she get chat records, screen recordings, and even a video showing dates and phone numbers. Daddy Freeze caution am sharply against posting such materials online, warning say privacy laws no dey smile. But Doris stand her ground, say court go handle everything.

As of now, Pastor Chris never issue any public response to this latest development, no statement, no sermon follow-up, just silence.

But Internet shock the more when video appear showing Pastor Okafor and one babe wey dem say be the new bride. Dem say na the marriage to the woman cause the entire wahala.

Accusations still dey fly, opinions still dey multiply, and facts still dey wait for courtroom light. But when power, affection, visibility, and wounded ego jam, explosion no dey need petrol. As the story still dey unfold, Nigerians dey watch with one eye, gist with the other because this matter never reach final bus stop yet.

Spiritual power meets N150 million: The Oyo governorship clash

Omooo, my Aprokonation, this gist go make you shout “Naija politics no dey carry last!”. This week, Lagos catch cruise as Primate Elijah Ayodele, oga of INRI Evangelical Spiritual Church, run mouth say N150 million no reach to buy him shoe. Yes oo, no be house, not car, na shoe. The man just dey flex spiritual power like limited edition drip.

During him Sunday service for Oke Afa, Lagos, Primate unleash fire on Bayo Adelabu, Minister of Power, wey allegedly waka go DSS complain say Ayodele dey demand N150 million plus 1,000 trumpets or saxophones to make him become Oyo governor.

According to Adelabu, when him refuse, the cleric allegedly start dey yan prophecies wey fit damage him image. But Primate just burst laugh, call the minister “small boy wey no sabi wetin him dey talk.” Na so him begin dey shake body with energy wey fit make church ceiling start to hot.

Ayodele drag the matter well-well, talk say “Can N150 million buy my shoe? Can N150 million buy my car? Abeg, leave that person alone. I carry something wey big pass me!” You hear am na, him dey talk as if say spiritual power na Gucci bag wey no fit get price tag.

According to Ayodele, him no dey do prophecies for money, him no dey collect money from anybody, and if him collect, him go announce am like headline for Sunday paper.

The minister dey claim person go get local musical instruments for N50 million, imported ones for N130 million. But Primate laugh am, talk say “E dey pain the boy because him sabi say him go lose again.

According to am, “I no dey do prophecies to impress anybody. Take am or leave am. If I fit disappoint, e dey only happen when you no be good person.” Ayodele talk as him wave hand dey mock the minister for altar.

So my people, make una reason am well: one man dey claim say him no fit pay N150 million plus buy 1,000 trumpets and saxophones for spiritual intercession, another dey yan say N150 million no even fit buy him shoe. Naija truly no dey ever carry last, cos politics, prophecy, and designer price tag don waka enter one proper gbege.

But in the end, spiritual power fit don get price tag, and Naija politics na pure wahala plus drama. My loves, if you dey plan to buy blessing, make sure e no dey come with 1,000 trumpets and N150 million receipt ooo.

When DNA drama enters demolition

Nigeria don see many family disputes, but this one climb ladder enter roofing level. According to the second wife, DNA test don talk say her pikin na Alhaji Waziri own, 99.99 percent sure, but first wife no gree hear word. Instead, she allegedly call police and DSS, come supervise as dem dey waka carry her roof comot like say na free demolition day.

For the video wey she share, madam dey dey shout as men dey peel zinc like roasted corn. She shout say, “Na my husband first wife send dem! She say na me dey lie, after ₦500k lab result show say pikin na Waziri get am. Now dem don remove roof!”

People dey shake head for screen, dey try decode why love story don turn demolition saga.

Second wife claim say wahala start after first wife insist say pikin no be her husband own. Madam do DNA like proper scientist, results land like jackpot; almost 100% sure. But instead of settling the matter, she allege say her oga’s first wife waka bring lawyer paper, come even send police and DSS to supervise the whole demolition.

Before you fit blink, men don show, zinc don dey waka comot from roof. People for online dey shake head, dey mutter, “Polygamy don show e true colours again o.”

Social media no sleep. Some people dey question why police go dey handle roof demolition matter wey DNA result don show. Others dey throw blame for Alhaji himself cos “If oga settle the two wives, e no go reach this stage.”

One sarcastic user add, “Wetin concern co-wife with roof and DNA when papa still dey alive?” E clear say Nigerians dey entertain themselves while shaking head.

Even speculation dey fly like small plane. Some dey reason say na land or property wahala dey hide behind all this. Some dey say na power play. Others dey laugh, dey call am karma show. Fact be say, nobody fit tell which side get sense.

Till now, no police or DSS officer don talk, Alhaji sef dey quiet like him phone don finish battery. Meanwhile, second wife dey stand with her pikin and camera, dey give social media daily dose of drama. Las las, even 99.99% DNA no fit guarantee peace inside house.

“Southerner Xtra
Trending with Nancy Mbaegbu

Related posts

Leave a Comment